Ticker

6/recent/ticker-posts

Nobody Wan Die

Police: Paaarrk! Wey ur particulars?

Me: Here they are.

Police: They are incomplete.

Me: Check them well, they are complete

Police: Do you want to teach me my work? By the way where
you dey come from by this time of the night?

Me: I go burial

Police: Who die?

Me: Na one Policeman

Police: Wetin kill am?

Me: He collect juju money from one driver for check point
and him hand come swell he come die.

Police: Na your friend?

Me: No

Police: Your relation?

Me: No

Police: Wetin you come go do for the burial?

Me: I go remove the money from the dead man hand.

Police: Wetin concern you for the matter

Me: Na me be the native doctor wey do the juju

(The policeman was staring at me now)

Me: Oga police, I beg I don tire, make I find you something
make u let me dey go.

Police: Police is your friend, we no dey collect bribe
again.

Me: Thank you sir... but I just want to appreciate you.

Police Oga abeg go na, I no want... shuoo, infact I no be
police i be vigilantee















































Una Happy Weekend oooh.

Post a Comment

0 Comments